22.5 C
New York
Monday, October 13, 2025

Latest Posts

How FG plan to share 50,000 naira to help 100,000 homes for states across Nigeria?

President Bola Ahmed Tinubu don direct di sharing of money to plenty plenty families for di 36 states of Nigeria as part of goment effort to reduce di hardship wey pipo dey face.

For di National Economic Council meeting on Thursday, di presido tok say goment go distribute “50,000 naira uplift grant each to 100,000 families per state for three months”.

Dat na N5 billion per state, N185 billion for di 36 states plus FCT, and N555 billion for di three months.

Dis project follow for a new ‘National Construction and Household Support Programme’ wey Presido Tinubu tok say im administration dey kickstart.

Di programme go also include “deployment of N155 billion to buy and sell assorted foodstuff wey goment go distribute across di nation”.

120

Latest Posts

Don't Miss

Stay in touch

To be updated with all the latest news, offers and special announcements.